Unfathomable Mercy: A full length TV drama series 13

By Nze Ujunwa MarkAnthony

(All Rights Reserved)

 

37. INT.PARK.DAY.

BANJO presents a subtle and fraudulent BUSINESS PROPOSAL to JEFF, trying earnestly to convince him accepting the OFFER.

 

 BANJO 

Jeff, how you dey now?

(Jeff, how are you?)

 JEFF

Oga chairman, I just dey, struggling to survive as I dey look God

face.

(My boss, chairman, I’m just there, struggling to survive)

 BANJO

E go soon better if only you go fit do this business wey I wan show you.

(It will soon be better if only you’ll do this business I want to show you)

 JEFF

Oga chairman, which business be that one?

(My boss-chairman which business is that?)

 BANJO

E dey simple but na smart business wey go give us better money no be this ground nut money wey we de get here.

(It’s a simple but smart business that will bring us good money not this pea nut we’re getting here)

Read Also: Unfathomable Mercy: A full length TV drama series 12

 JEFF

Oga Banjo, all this one wey you dey talk since na story, make you put me in the picture of things now.

(My boss, all this you’ve been saying since is story just put me into the deal proper)

 BANJO

Oh! Boy, you get liver to do am so?

 JEFF

Oga BANJO, haba! Why you dey talk like this now? You no know who I be? Me, I be Okuru meta abo o!

(My boss, why are you talking like this? Do you know who I am? I’m three men in one.)

 BANJO

Omo ibo, okuru meta abo! We go see when time come.

( Igbo boy, three men in one! When time comes we shall find out)

 

38. EXT.PARK.DAY.

Later that DAY. MR BANJO driving out in his BUS and JEFF hurries to meet him.

 JEFF

Oga Banjo! Oga Banjo! Abegi, wait make I see you sharp,sharp before you commot.

(Boss, please wait let me quickly see you before you leave)

 BANJO

…the camera cuts-away with a close-up shot from his ankle to the feet as he slams his right foot on the brakes.

Omo ibo, I don dey look for you since where you come go?

(O’ boy, I have been looking for you where did you go?)

 JEFF

Oga, I be dey for dey park extension dey collect money for ticket.

(Boss, I have been at the park’s extension collecting ticket)

Read More